Friday 27 June 2014

JOKE OF THE DAY- PSALM 23 IN PIDGIN

Psalm 23 in pidgin English!
Finally the new NIGERIA PIDGIN
ENGLISH BIBLE is out.
one of the popular chapter is psalm 23, which reads :
1. The Lord na my shepherd, i
dey kampe.
2. E make me sidon
for where
betta dey flow and come put
me
next to stream make mai bodi
thermacool.
3. E panel beat mai soul come
spray am white, come dey lead
me dey go through express
road
of righteousness sake of Hin
name.
...4. Walahi!, if I waka pass
where
arm robber, 419 and juju people
boku, come even join boko
haram reach valley of the
shadow

of death sef,mai bodi dey inside
cloth. Your rod and staff nko ?
Na so dem dey like back bone
dey comfort me.
5. You don prepare good food
on
top d table make I chop. All mai
enemies dey look waa waa. You
rub me for head wit vaseline
intensive lotion. mai cup na River
Niger wey overflow hin bank.
6. True true, betta life and
mercy go gum mai back till I
quench.
And man pikin go tanda for God
house from lai lai to lai lai. GOD
ALMIGTHY NA YOU BIKO AMEN.
Type Amen

No comments:

Post a Comment